43 Jesus ask dem again, “Den, how kom David koll am, ‘Oga God’, thru God Spirit, wen e sey,
“God Spirit dey tok thru mi; en message dey for my lip.
Di Holy Spirit pawa make David tok sey, “ ‘God tell my Oga God, sidan for my rite hand until I go put yor enemies under yor leg.’
“My brodas, di word wey di Holy Spirit use David tok about Judas, wey show road to di pipol wey arrest Jesus Christ, must happen,
Naw, I wont make una know sey, anybody wey God Spirit dey lead, go sey, Jesus naim bi Oga God and e nor go ever curse am.
As di Holy Spirit tok: “If una hear God vois today, make una listin to am!
bikos know profesy don ever kom out from human being mind. Instead, na di Holy Spirit dey kontrol di pipol wey dey tok God word.
On Sunday, God Spirit kon dey kontrol mi and from my back, I kon hear one loud vois like trumpet dey sey,
So for di vishon, I si one throne for heaven wey pesin sidan put!