37 Jesus ansa, “Make pesin love God with all en heart, with all en soul and with all en mind.
“Tisha, wish kommandment big pass?”
Na dis bi di first kommandment and naim big pass.
To love God with all awa heart, mind and pawa and to love awa neighbour as awasef big pass all di sakrifice and ofrins wey pesin fit give God.”
Di man ansa, “Make yu love God yor Oga God with all yor heart, yor soul, yor pawa and mind, den love yor neighbour as yu love yorsef.”
Pipol wey dey sin, na God enemy dem bi, bikos dem nor obey en law, since dem nor fit obey am.
Naw, Israel pipol, wetin di Oga una God wont from unasef? E wont make una dey fear am kon dey live di kind life wey E wont make una live. E wont make una love, respet and serve am with all una soul and heart.
Di Oga una God go sekonsaiz una and una shidren heart by ensef, so dat una go love am with all una heart and soul, den una go get betta life.
Israel pipol! Make una listin! Di Oga na awa God and God na one!
So una must love di Oga una God with all una heart, all una soul and all una pawa.
God don kommand us sey: “If anybody love mi, make e love en broda and sista for Christ too.”