Di king wey Yu put ova us, bikos wi sin, na-im get evritin wey di land dey produce. Na wetin dem like dem dey do with wi and awa animals and wi really dey sofa for dia hand.
Pita ansa, “Yes.” As Pita enter di house, Jesus kon ask am, “Wetin yu tink, Simon? Who dey pay tax give kings for dis world? Na pipol for di kountry or strenjas?”
Tiberius Caesar don dey rule for fifteen years wen Pontius Pilate bi govnor for Judea and Herod dey rule Galilee, en broda Filip dey rule Iturea and Trakonitis aria and Lysanias dey rule Abilene.
But wi go like to hear wetin yu dey tish from yor own mout, bikos wi know sey evribody for di whole world dey take mout kondemn dis group wey yu dey inside.”
Afta am, Judas wey kom from Galilee kom out wen dem dey do census. E push pipol to join am oppoz wetin dem dey do. Dem still kill-am and all di pipol wey dey follow am skata too.