8 Many pipol spread dia klot for road. Odas kut palm leaf kon spread dem for road too.
So each of dem kwik-kwik remove dia klot kon spread dem put for Jehu leg for di step. Dem blow di trumpet kon shaut sey, “Na Jehu bi king!”
For dat day, una go take some of di good fruit from una tree, palm tree branches wey get leaf well-well kon celebrate to honor God.
Dem bring di donkey kon put dia klot make Jesus for sidan on-top.
Many pipol spread dia klot for road and some oda pipol spread palm leafs wey dem kut from bush.
As Jesus dey ride dey go, pipol kon spread dia klot for road.
Di pipol take palm tree leaf go wait am for road. Dem kon bigin shaut, “Hosanna, make God bless di pesin wey E send kom meet us. Make God bless Israel king!”