Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 21:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 But if wi sey, ‘Na from pipol,’ wi dey fear di pipol, bikos dem bilive sey na profet John bi.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 21:26
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God sey, “Who bi all dis gods wey make una dey fear and lie for mi? Wey make una forget mi like dis? Una don stop to honor mi, bikos I don too kwayet?


Wetin una go si for outside? Na profet? Yes! I tell una, e even big pass profet.


Herod kon get mind to kill John, but e dey fear di pipol, bikos dem bilive sey, John na profet.


Pipol wey dey follow Jesus kon sey, “Dis na Jesus, di profet from Nazaret wey dey Galilee.”


Where John baptizim from kom? Na from heaven or pipol?” Dem kon dey tok about di matter among demsef sey, “If wi sey, ‘Na from heaven,’ E go sey, ‘Den why una nor bilive am?’


So dem ansa Jesus, “Wi nor know.” Jesus kon tell dem, “Misef nor go tell una wish pawa I take dey do all dis tins.”


So dem kon dey try to arrest Jesus, but dem dey fear, bikos di pipol bilive sey na profet e bi.”


But wi nor fit sey, ‘Na from pipol.’ ” bikos wi dey fear dis pipol, (since dem bilive sey John na profet).


Naw, dem won kon arrest am, but dem dey fear di pipol, bikos dem know sey Jesus tok dis parabol against dem. So dem kon waka leave am.


Herod dey fear John well-well, so e dey protet am, bikos e know sey John na holy man wey dey do wetin God like. Anytime Herod hear John dey prish, en mind go dey worry am, but e still dey like to listin to am.


Den di Farisee pipol and di law tishas won kon arrest Jesus for dat place, bikos dem know sey Jesus dey tok against dem. But dem dey fear di pipol.


But if wi sey, ‘Na from pipol’, dis pipol go stone us, bikos dem bilive sey, John na profet.”


Di priest oga dem and di law tishas dey fine how dem go take kill Jesus, but dem dey fear di pipol.


John lite shine well-well for small time and una happy wen una si en lite.”


(En papa and mama tok like dis, bikos dem dey fear di Jew oga dem wey don tok sey, “Anybody wey tok sey na Jesus bi di Christ, dem go drive am komot from di sinagog.”


So di soja oga wey dey di temple kon escort di savant go bring di apostles, but dem nor use force, bikos dem dey fear sey di pipol wey gada der, fit stone dem.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ