Make una stay for dat house, chop and drink anytin wey dem give una, bikos anybody wey dey work, suppose to get en pay. Make una nor dey waka from one house go anoda.
Jesus ansa, “Who bi di manaja wey get sense and nor dey do wayo? Na pesin wey di oga put make e kare and give di oda savants dia food for di rite time?
Una must pay dem for dia work evriday wen evening rish, bikos dem poor and dey wait dat money. If una nor pay dem, dem fit kry give God and di sin go dey una head.
Make pesin wey bi leader nor get fault, bikos na God work e dey do. Make e nor dey karry body up; dey kwik vex or drink anyhow; dey like to beat pipol or love money.