6 Wen five oklok for evening don nearly rish, e si some pipol wey nor get work and e ask dem, ‘Why una nor dey work and today don nearly finish?’
If yu like, dey lazy and dey sleep anyhow, but make yu know sey honga go soon kom kill yu.
So, anytin wey yu dey do, make yu do am well, bikos wons yu die, yor wisdom, knowledge, work and plans, nor go mean anytin again.
“Yor sista and en pikin dey karry body up, bikos dem get enough to chop and dem dey stay for peace, but dem nor gri kare for poor pipol and doz wey nor get to chop.
So dem kon go. Wen e go out around twelf and three oklok for aftanoon, e still tell oda pipol make dem go work for di farm.
“Dem ansa am, ‘Na bikos nobody hire us.’ “E kon tell dem, ‘Make una enter my farm go work.’
“Pipol wey dem hire for five oklok, kollect full day salari.
I must do di work for di Pesin wey send mi before day go dark, bikos nite dey kom wen nobody go fit work.
(Atens pipol and odas wey dey der, nor get any oda work pass make dem sidan dey tok story about any new tin wey dey happen.)
So make any of una nor taya, but make una dey patient and bilive, so dat una go gain God promise.