4 E kon tell dem, ‘Make una go work for my farm, I go pay una well.’
“Wen nine oklok rish for morning, e kon si pipol wey nor get work stand for market.
So dem kon go. Wen e go out around twelf and three oklok for aftanoon, e still tell oda pipol make dem go work for di farm.
As Jesus komot from der, e si one man wey na name bi Matiu, wey sidan for where dem for dey pay tax. Jesus kon tell am, “Follow mi.” At wons, di man kon get up follow am.
Na so some among una bi before, but naw, God don wosh una klean thru Jesus Christ name and en Spirit pawa, don make una klean for en eye.
Una wey bi masta, make una trit una savants well and nor shit dem, bikos una know sey, unasef get masta for heaven.
Dis word wey I dey tok so na trut and I wont make yu make sure sey evribody wey trust God dey do good. Dis tishing dey good and e go help evribody.
So, make una always dey ready for akshon. Make una shine una eye and put hope for di grace wey Jesus Christ go bring.