27 and anybody wey wont bi first among una, must bi savant to di odas,
Anybody wey bring ensef down like dis small pikin, naim big pass for God Kingdom.
Make e nor bi like dat among una! Instead, anybody wey won bi oga among una, must serve di rest pipol
just as Man Pikin nor kom make pipol serve am, but make e for serve and give en life to save many pipol.”
But una nor suppose to bi like dat; di pesin wey big among una, must do like sey naim small pass and di leader, go bi like savant.
Bikos God sey make I prish to evribody, weda na Greek or Gentile pipol or weda dem wise or foolish.
I nor tink sey doz “supper apostle” betta pass mi.
I go dey happy to spend all my money and even my life, as long as una soul go dey save. Una love for mi dey small, bikos my love for una plenty?
Wi nor dey tok about awasef, but wi dey prish sey, na Jesus Christ bi Oga God and wi bi una slave, bikos of am.