Jerusalem, make una wake-up! Make una karry unasef up! Una don drink from di ponishment cup wey God give una, bikos E dey vex. Una drink am and e dey make una stagga.
di Oga wey bi una God dey defend una naw sey, “I dey take di cup wey I give una with vexnashon. Una nor go drink di wine wey dey make una stagga again.
God still sey, “Even doz wey I nor suppose ponish, go drink from di ponishment cup. Abi una bin tink sey I nor go ponish una? No! Una must drink from dat cup!
E waka go front small kon liedan face groun, den e kon pray, “My Papa, if yu wont, yu go fit remove dis deat from mi! But nor bi as I wont, na as yu wont am.”
Na so too di Holy Spirit dey help us bikos wi dey weak. Bikos wi nor know wetin wi suppose to pray for, di Spirit by ensef dey kry beg God, for di way awa word nor go fit esplain.