20 Den Zebedee wife with en shidren, James and John kom meet Jesus. Dia mama kon knee down dey beg Jesus.
Dis na di twelf disciples name: Simon (wey dem dey koll Pita); Andru, wey bi Pita broda; James wey bi Zebedee pikin and en broda John,
Den di oda disciples for di boat kon bow down for Jesus front woship am sey, “True-true, yu bi God Pikin.”
Di woman knee down for en front kon dey beg am sey, “Oga God, make yu help mi!”
Dem enter di house, si di pikin with en mama kon knee down woship am. Den dem open dia bag kon gi-am some gifts wey bi, gold, frankincense and myrrh.
Mary Magdalin, Mary, wey bi James and Josef mama and Zebedee shidren mama, dey der too.
Wen dem si am, dem woship am, but some among dem kon dey doubt.
As Jesus komot from der, e kon si two brodas, James and John, with Zebedee dia papa, dey ripair net inside dia boat. Den Jesus koll di brodas.
One leper kon meet am, knee down for en front, kon sey, “Oga God, if yu wont, yu go fit heal mi, so dat my body go well.”
Some wimen dey der dey look from far. Dem bi Mary Magdalin, Mary wey bi Josef, James and Salome mama.