20 kon tell am, “Make yu get up, karry di pikin and en mama go Israel, bikos di pesin wey won kill-am, don die.”
Wen Hadad hear for Egypt sey King David and Joab en soja kommander don die, Hadad kon tell di king, “Make I kon dey go back to my own kountry.”
So, Solomon kon try to kill Jeroboam, but Jeroboam run go meet King Shishak for Egypt kon stay der till Solomon die.
God tell Moses for Midian, “Make yu go Egypt back, bikos all di pipol wey get mind to kill yu, don die.”
Wen di wise men don go, God angel kon tell Josef for dream, “Get up, karry di pikin and en mama run go Egypt, make una stay der until I go tell yu wetin una go do, bikos Herod won kill di pikin.”
Afta Herod die, God angel appear to Josef for dream wen e still dey Egypt,
So, e karry di pikin and en mama go Israel back.