My pipol, make una nor fear; make Israel pipol nor fear at-all. I go save una from di far land where una dey as prisonas. Una go kom back to una house kon stay for peace and nobody go make una fear again.
“Naw, make yu tell doz wey dey with yu wetin I dey tok so. Na mi send dem go stay for strenj land kon skata dem for evriwhere. Yes, I go still dey with dem for di land wey dem dey.
With en wayo, e go prosper as e dey lie and deceive pipol. E go dey bihave anyhow kon distroy many pipol without sey e first warn dem. E go fight and win kings wey get strong pawa, but e go skata wen nobody tosh or fight am.
As e dey tink how e go take leave am, God angel show ensef to am for dream kon tell am sey, “Josef, David pikin, make yu nor fear to marry Mary, bikos di pikin wey dey en belle, na Holy Spirit gi-am.
But wen e hear sey Arkelaus dey rule for Judea, afta Herod en papa don die, Josef kon fear to go der. Afta God don warn am for dream, e kon go Galilee.
As Pilate sidan for di judgement seat, en wife send message go meet am sey, “Nor put hand for dat innocent man matter, bikos last nite, I dream bad dream about am.”