Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 2:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Dem enter di house, si di pikin with en mama kon knee down woship am. Den dem open dia bag kon gi-am some gifts wey bi, gold, frankincense and myrrh.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 2:11
33 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den dia papa Israel tell dem, “If na so e go bi, den make una do dis tin for mi: Make una karry some among di best tins wey wi get put for una bags kon give di man as gift; small balm, honey, spices and myrrh, pistachio and almond.


Sheba kween give Solomon all di gifts wey e bring and dem heavy rish 120 pounds for gold, with plenty spices and jewels. Di spices wey e give Solomon, plenty pass di ones anybody don ever gi-am before.


E karry plenty pipol follow body kon load spices, jewels and plenty gold full en kamels. Wen di kween si Solomon, e kon ask am all di kweshon wey dey en mind.


Make una dey respet God well-well or E go fit vex kon distroy una at wons, bikos of di way una dey bihave. But na blessing dey follow doz wey si am as dia Oga God!


Na myrrh, aloe and kassia dem spray as perfume for yor klot. Dem dekorate yor palis with ivory and na harp dem take dey entertain yu for der.


Tarshish kings for west and di oda kings go kon pay respet to am. Sheba kings for east and Seba go kon gi-am gifts.


Di king go live forever! Dem go dey gi-am gold from Sheba and di pipol go always dey pray and bless am evriday.


Kom! Make wi go woship and bow to am. Make wi knee down before God wey make us,


“Make yu selet betta spices like: twelf and half pounds of pure myrrh, sinamon wey get betta smell and make e bi six and one kwota pounds, sugarcane go bi six and one kwota pounds,


God kon tell Moses, “Make yu take spices like: gum, resin, onyx, galbanum and pure frankincense and dem go bi di same amount.


Who dey waka kom from di desert like smoke or like incense and myrrh? Na fine incense wey dem dey sell?


Plenty karavan with kamels go kom una land from Midian and Efah town. Dem go kom give una gold and incense from Sheba town. Pipol go tok about di good tins wey God don do for una!


and di priest go pak some of di flower, di oil and di incense for di top kon burn am on-top di altar as sakrifice to God. God dey like dis ofrin smell.


God sey, “From east go rish west, pipol go honor my name for evriwhere. Dem go burn betta incense and offa betta sakrifice give mi, bikos my name go dey great among all di nashons.


one gold pan wey heavy rish ten shekel and incense full am;


Di twelf gold pans wey incense full heavy rish ten shekel and na akordin to di sanctuary shekel; all di pan wey bi gold heavy rish one hundred and twenty shekel.


Dis na how dem take born Jesus Christ. Wen Mary en mama don ready to marry Josef, before dem bigin sleep togeda, Mary kon si sey e don get belle with Holy Spirit pawa.


As Jesus still dey tok, en mama and brodas kon stand for outside, bikos dem won si am.


Den di oda disciples for di boat kon bow down for Jesus front woship am sey, “True-true, yu bi God Pikin.”


dey ask, “Where di Jew king wey dem just born? Wi si di star wey tok about am, so wi kom woship am.”


Dem kon go si Mary, Josef and di pikin for inside di animal house.


For dat time, e kom meet Josef, Mary, di pikin and Simeon kon bigin tank God, dey tok about di pikin give evribody wey dey wait for di time wen God go free Jerusalem.


Nikodimos, di man wey hide go si Jesus for nite, kon follow Josef. E karry perfume wey heavy rish seventy-five pounds, wey dem take myrrh and aloe spice make.


So, I kon bow make I for woship di angel, but e sey, “Nor do dis tin! I bi savant and broda like yu wey whole di trut about Jesus well. Make yu woship only God, bikos na di profesy spirit bi di true word about Christ.”


And wen e take di book, di for creatures and di twenty-four eldas fall for di Lamb front. Each of dem whole harp and basin wey incense full. Dis incense na God pipol prayers.


But some wiked pipol sey, “How dis man go fit take save us?” Dem curse am and dem nor gri kom gi-am gift. But Saul nor tok anytin.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ