Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 19:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Naw I tell una, anybody wey drive en wife, wey nor bi sey e sleep with anoda man, but kon marry anoda woman, don kommit adultery.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 19:9
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But for dat nite, God kon appear to Abimelek for dream sey, “Na die yu won die so, bikos di woman wey yu take so, na somebody wife.”


E still build juju place for Judah hills, den Jerusalem and Judah pipol nor kon dey obey di Oga dia God.


God sey, “If man drive en wife and di woman go marry anoda man, di man go fit go marry di woman again? Dat kind tin go make di land dirty. But Israel pipol, una bi ashawo wey get many husband and naw, una won turn back kom meet mi.


I drive Israel pipol, bikos of dia ashawo life, yet en sista, Judah, nor fear, but e kon join dey do ashawo too.


“Bikos yu fine, yu kon bigin do anyhow and dey sleep with anybody wey yu si.


Yu still bi ashawo for Babilon wey get business men, but dem nor rish yu too.”


“ ‘ “As I dey waka pass again, I kon si sey di time wey yu suppose to undastand wetin love mean, don rish. So, I kover yor naked body with my klot kon promise sey I go always love yu. Yes, I marry yu and yu kon bi my own.” ’ ” Dis na wetin God wey get pawa dey tok.


Di disciples kon tell Jesus, “If na so husband and wife matter bi, e betta make pesin nor marry at-all?”


Jesus ansa, “Moses sey make una drive una wife, bikos una heart dey wiked, but nor bi so God plan am from biginnin.


But I dey tell una naw sey, anybody wey drive en wife komot from marriage, wey nor bi sey di woman sleep with anoda man, don make di woman kommit adultery and any man wey marry di woman, don kommit adultery too.”


“Any man wey drive en wife, den marry anoda woman, don kommit adultery and di man wey marry woman wey leave en husband, don kommit adultery too.”


I don dey hear bad-bad tins about some of una. And una own even worse pass wetin doz wey nor know God dey do. Sotey man dey sleep with en papa wife.


Wife suppose to stay with en husband until di man die. Den e fit go marry again, but di new husband must bi pesin wey dey follow Christ.


Nor bi di wife get en own body, but na di husband get am and na so too di wife get en husband body.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ