Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 19:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 and bikos of dat, ‘Man go leave en papa and mama go join en wife and di two of dem go kon bi one?’

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 19:5
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den en mind nor gri komot di girl body again. E love di girl kon dey tok to am well.


Jonatan my broda, si as I dey kry for yu! I love yu with all my heart, bikos di love wey yu get for mi, deep pass di one wey dem dey love woman.


E marry dem, even doh God don kommand Israel pipol make dem nor marry from doz kountries, bikos dem go make Israel pipol woship oda gods.


All my princess, make una listin to mi kon keep wetin I tok for una heart. Make una forget una pipol and family wey dey far-far.


I hold Yu tait, bikos na yor strong rite hand dey save mi.


God nor sey, una and una wife go bi one body and spirit? Wetin make am tok like dat? Na bikos make una for get shidren, wey go bi God pipol. So, make una make sure sey, una nor break di promise wey una make with una wife.


Dem nor bi two again, but one. So, wetin God don join togeda, make nobody skata am.”


Make wi love each oda well-well. Make una hate anytin wey dey bad, but una must love anytin wey get trut.


Una nor know sey, pesin wey dey sleep anyhow with oda pipol, don bi part for di pipol body?


But make una nor for dey do ashawo, e betta make una marry.


Nor bi di wife get en own body, but na di husband get am and na so too di wife get en husband body.


Na bikos of dis, man go live en papa and mama go join en wife and di two of dem, go bi one flesh.


Una must fear di Oga una God kon woship and love am. Wen una swear, e go must bi with en name.


Make una dey kareful as una dey obey all di kommand wey I dey give una today. Make una show love to di Oga una God kon bilive and do as E sey make una do.


But all of una wey dey faithful to God still dey alive till today.


Wen David don tok to Saul finish, en and Jonatan kon turn tait friend. Jonatan like David as e like ensef.


David don already marry Ahinoam from Jezrel and di two of dem kon bi en wife.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ