Jesus ansa am, “I tell yu true word, for dat time wen evritin go dey new, Man Pikin go sidan for en throne wey get glory and una wey dey follow mi, go sidan for twelf thrones, dey judge di twelf tribes wey dey Israel.
As Jesus komot from der, e si one man wey na name bi Matiu, wey sidan for where dem for dey pay tax. Jesus kon tell am, “Follow mi.” At wons, di man kon get up follow am.
So, e tell en papa, ‘Si, all dis many years I dey work like slave for yu and e nor get anytime wey I disobey yu, but yu neva give mi even one small goat make I do party with my friends.
Wetin make una tink sey, una betta pass anoda pesin? Nor bi God give una evritin? So wetin make una dey boast wen e bi sey evritin wey una get, na God give una?
Nor bi only doz ones, but naw, I dey look evritin as nor-tin, wen I kompare am with Christ, my Oga God wey I know and I trowey evritin, bikos of am. True-true, I dey look all doz tins as yeye, so dat I go fit gain Christ,