25 Di disciples sopraiz wen dem hear dis tins and dem kon ask, “Den who go fit dey save?”
Again, I dey tok sey, e go eazy for kamel to pass thru nidol whole, dan for pesin wey get money well-well to enter God Kingdom.”
Jesus look dem kon ansa, “E nor possibol for human being, but evritin dey possibol with God.”
And if God nor reduce di days wen dis tins go happen, evribody go die finish. But bikos of di pipol wey God choose, e go reduce di days.
If God nor kut doz days short, nobody go save. But bikos of di pipol wey God don choose, E don make doz days short.
bikos E go save doz wey dey koll en name.