Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 19:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Wen di yong man hear wetin Jesus tok, e vex waka komot, bikos e get money well-well.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 19:22
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

My God, with di pawa wey dey yor hand, make Yu distroy pipol wey dey espect dia reward from dis world. But doz wey Yu like well-well, make Yu give dem enough and dia shidren go get plenty kon die leave propaty for dia shidren-shidren.


So all di pipol gada kom listin to yu, but dem nor gri do wetin yu tell dem. Dem sey dem dey do di rite tin, but dem dey always dey shit and tif pipol money.


Di seed wey fall for shuku-shuku, na pesin wey hear God word, but wahala, long-trot and to kwik get money for dis world kon shuk di word die for en heart and e nor kon bear fruit.


Di tin pain di king well-well, but as e don promise and bikos of di pipol wey kom di party, e kon kommand make dem go kill John.


Wetin pesin go gain, if di whole world bi en own, but e luz en soul? Or wetin pesin go fit give take pay for en soul?


Jesus tell am, “If yu won dey pafet, go sell evritin wey yu get, den give di money to poor pipol and yu go get betta tins for heaven. Wen yu don do wetin I tok, den make yu kom follow mi.”


Den Jesus tell en disciples, “I tell una true word, e go hard for pesin wey get money well-well to enter God Kingdom!


“Nobody go fit serve two oga, e go hate one kon love di oda one, or e go serve one with all en heart and nor respet di oda one. Nobody go fit serve God and money for di same time.


Wen di man hear dis word, e vex komot der, bikos e get plenty money.


Even doh e pain di king well-well, e nor won rijet wetin di girl ask, bikos e don promise for evribody present.


Wen di man hear dis one, e kon dey vex, bikos e rish well-well.


I tell una true word, una go kry and mourn, but di world go dey happy; una go dey sad well-well, but una sadnes go turn to happiness.


One tin wey una must know bi sey, pesin wey dey sleep with who e nor marry; wey nor dey pure or wey get long-trot and dey serve juju, nor go enter Christ and God kingdom.


So make una kill evry bad karata wey dis world dey bring: Like to dey sleep with pesin wey una nor marry; dey bihave anyhow; follow dis world tins; dey do bad tins; long-trot and to serve juju.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ