Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 19:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Jesus ansa am, “Why yu dey ask mi about wetin good? Na only God good. So if yu wont enter heaven, make yu keep God kommandments.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 19:17
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu warn dem sey make dem obey wetin Yu tish, but dem rijet yor law bikos of pride and even doh yor law dey give life, dem nor gri obey am, bikos of dia strong head and sturbones.


Yu dey good and na only good tins Yu dey do; so make Yu tish mi yor kommand!


Yu wey tink sey yu strong, why yu dey karry body for di bad tins wey yu dey do? Yu nor know sey God love dey always protet mi?


“But dat generashon still rijet mi. Dem break my laws and dem nor gri keep my kommand wey dey give life to doz wey obey am. Dem distroy di Sabat finish. So, I dey ready to make dem feel as my vexnashon strong rish and I like to kill all of dem as dem dey di wildaness,


So una must keep my law and kommandment; anybody wey do like dat, go get long life. Na mi bi God.


Na dis raitiousness wey di law tok, naim Moses rite about sey: “Di pesin wey follow di law must do evritin wey di law tok.”


bikos evry betta and pafet gift dey kom from God. E dey kom down from di Papa wey kreate lite and E nor dey shange.


Wi know and bilive sey, God love us and en love dey inside us.


Nobody dey holy like God! E nor get anybody wey strong like Yu! E nor get any rock wey bi like God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ