9 If yor eye dey make yu sin, make yu pul am trowey. E betta make yu enter God Kingdom with one eye, down sey God trow yu enter hell-fire with two eyes.”
If yor hand or leg dey make yu sin, make yu kut am trowey. E betta make yu enter God Kingdom without hand or leg, dan sey God trow yu inside fire wey nor dey kwensh.
But I tell una, anybody wey vex for en broda, God go judge am too. Anybody wey curse en broda, go face di kansol and anybody wey koll pesin, ‘Mumu’, go-go hell-fire.
If yor eye go make yu sin, make yu pul am komot! E betta make yu enter God Kingdom with one eye, dan to get two eye kon enter hell-fire wey nor dey ever kwensh,
Dem enkourage di disciples sey make dem get heart and make dem kontinue to dey bilive sey, “Wi go must sofa well-well for pipol hand, before wi go fit enter God Kingdom.”
But know dirty or yeye tin go ever enter di town. Pesin wey dey do bad or dey lie, nor go ever enter der, but di pipol wey go enter, na only doz wey dem rite dia name for di Lamb Life Book.