35 “So, na like dis too my Papa for heaven go do una, if una nor forgive una brodas from una heart.”
If yu nor gri listin to poor pipol kry, dem nor go hear yor own kry for help.
Pesin fit tink sey evritin wey e dey do dey korrect, but remember sey God dey judge evritin wey wi dey do.
Even with all dis tins, Israel sista wey bi Judah nor gri turn kom meet mi with all dia heart, but dem just dey pritend.” Oga God don tok.
Dia heart strong like rock and dem nor gri obey my profets wey dey among dem. So I vex kon ponish dem well-well.
With vexnashon, di king kon give di savant to soja make dem sofa am well-well, until e pay evritin wey e dey whole.
forgive us all di bad-bad tins wey wi don do, as wisef dey forgive odas di bad tins wey dem do us.
Anytime una dey pray, if una get anytin for mind against anybody, make una forgi-am, so dat una Papa wey dey heaven go forgive una too.
But if una nor gri forgive oda pipol, una Papa wey dey heaven nor go forgive una.”
But Jesus tell dem, “Na una dey make unasef good for pipol eye, but God know una heart. Bikos wetin human being value well-well, naim God nor like.
Judgement nor get mesi for anybody wey nor dey mesi for odas, bikos mesi betta pass judgement.
But if jealousy and sefishnes dey en mind, make e nor boast and lie against di trut.
Draw near God and E go draw near yu. Una wey bi sina, make una wosh una hand and una wey get doubol mind, make una heart dey klean.
I go kill all en shidren, den all di church pipol go know sey, I know wetin dey for pipol mind and heart. I go reward evribody akordin to wetin e do.