32 “So di king koll di first savant kon tell am, ‘Yu wiked savant! I forgive yu di big debt wey yu whole mi, bikos yu beg!
Di king sorry for di savant kon release am sey make e nor pay again.
Wen di oda savants si wetin happen, dem nor happy at-all, so dem kon go tell di king evritin wey happen.
Wetin make yu nor sorry for anoda savant like yu, just as I sorry for yu?’
“En oga kon tell am, ‘Yu wiked and lazy savant! Since yu know sey I dey harvest wetin I nor plant and dey pak fruits wey I nor plok,
“Di oga kon tell am, ‘Na yor word I go take judge yu, yu wiked savant! So yu know sey, I bi hash man; dey chop food wey nor bi my own and I dey plok fruit wey I nor plant?
Wi know sey wetin di law tok, na for di pipol wey dey under di law. Di law tok like dis, so dat nobody go get eskuse wen God go judge di world.
Judgement nor get mesi for anybody wey nor dey mesi for odas, bikos mesi betta pass judgement.