Na Jakob story bi dis: Josef wey bi seventeen years dey kare for di sheep with en brodas. Naw e bi small boy wey dey work with en papa wifes, Bilhah and Zilpah sons. Josef kon tell en papa bad tins about dem.
I wish sey my head bi like well wey wota full and my eyes bi like fountain where wota for dey rush kom out, den I go kry well-well both day and nite for my pipol wey dem kill.
“Afta, di same savant kon si anoda savant wey dey hold am hundred silva koins. E seize am for troat nearly kill-am kon tell am, ‘Make yu pay mi my money.’
So Jesus vex kon look dem round, bikos dia heart strong well-well, den e tell di man, “Stresh yor hand.” So di man stresh en hand and di hand kon well again.
“So di savant kom back kon tell en oga evritin wey dem tok. Di oga vex well-well kon tell di savant, ‘Make yu go all di street and korna-korna wey dey dis town, go bring poor pipol: pipol wey dia leg or hand kut komot and pipol wey nor fit waka kon di party.’
(Na shame for mi, but I must tell una sey awa heart nor strong rish to do una doz kind tins!) But anytin wey anybody fit boast about (I dey tok like fool naw o-o), misef fit boast about dat tin too.
Make una obey una leaders and do evritin wey dem tok, bikos na dem dey kare for una soul and dem go ansa God wen E ask dem how dem do dia work. Make una let dem do am with happiness, nor bi with komplain, bikos una nor go get any betta tin from am.