Den E tell mi, “Go make dis pipol get strong heart, deaf dia ear and blind dia eyes, so dat dem nor go si, hear or undastand again. If dem bi like dat, dem go turn kom meet mi and I go heal dem.”
Dis pipol nor go fit undastand; dem nor won hear anytin, dem klose dia eyes make dem nor for fit si and hear with dia ear. Dia mind don block, so dem nor go fit undastand, but if to sey dem fit turn kom meet mi, I for heal dem.’
“Wen una dey fast, make una nor skwiz una face like pipol wey dey pritend, so dat pipol go si sey dem dey fast. I tell una true word, dem don already get dia full reward.
“Anytime una give sometin to pipol, make una nor show unasef as pritendas dey do for dia sinagog and road, so dat oda pipol go praiz dem. I tell una true word, dem don already get dia reward.
“Anytime wey una dey pray, make una nor do like pipol wey dey pritend, wey like to dey stand pray inside sinagog and for road, so dat pipol go si dem. I tell una true word, dem don already get dia reward.
so dat, “dem go dey look, but dem nor go si, dem go dey hear, but dem nor go undastand and dem nor go fit turn from dia sin kom meet God make E forgive dem.”
Dem enkourage di disciples sey make dem get heart and make dem kontinue to dey bilive sey, “Wi go must sofa well-well for pipol hand, before wi go fit enter God Kingdom.”
Una heart nor dey undastand and una ear nor dey hear well again. Devil don klose una eye, make una nor for fit si; hear with una ears or undastand with una heart, so dat una nor go fit turn kom meet God, make E for heal una.” ’
My brodas and sistas, make una stop to tink like small shidren. Instead make una dey tink like mature pipol and dey innocent like pikin wey dem just born.