26 “So, di savant fall for di king front dey beg, ‘Oga God, make yu dey patient with mi, I go pay yu evritin.’
“Di savant wey e seize for troat kon fall for groun dey beg am, ‘Make yu dey patient with mi, I go pay yu yor money.’
Dem enter di house, si di pikin with en mama kon knee down woship am. Den dem open dia bag kon gi-am some gifts wey bi, gold, frankincense and myrrh.
One leper kon meet am, knee down for en front, kon sey, “Oga God, if yu wont, yu go fit heal mi, so dat my body go well.”
Simon ansa, “Na di one wey en money big pass.” Jesus kon tell am, “Wetin yu tok, korrect.”
as e bi sey dem nor know how God dey take make pipol good, instead, dem dey try to make demsef good by dia own pawa, since dem nor gri do wetin God wont.