Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 18:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 Bikos e nor fit pay wetin e whole, di king kon orda make dem sell di man, en wife, en shidren and evritin wey e get, take pay di debt.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 18:25
9 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

One day, one woman wey en husband bi profet before e die kon kry go meet Elisha sey, “Yor savant my husband don die. Yu know sey yor savant dey follow God kommand. Naw, doz wey e dey owe money before e die, won kom take my two sons as slave.”


Wi bi Jew pipol too, awa shidren bi like dia own shidren. But wi sell awa shidren as slave give dem. Dem don sell some among awa dotas as slave. Wi nor get pawa or who go help us, bikos dem don take awa farms and vineyards from us.”


I kon sey, “Just as wi fit, wi don dey buy awa Jew brodas wey sell demsef give strenjas back. But naw, una by unasef won sell una own brodas! So how many times wey go buy dem back?” But di leaders kwayet and nor fit defend diasef.


“If una buy any Hibru slave, e go serve una for six years, but e go dey free for di sevent year and e nor go pay anytin.


“But if na for day time dem kill di tif, di tif blood go dey who kill-am head. “Tif wey dem katch must pay evritin wey e tif. If e nor get anytin, den dem go sell am take pay for wetin e tif.


Dis na wetin God tok: “Una tink sey I drive my pipol komot like man wey drive en wife komot en house? Where di leta wey I take drive una mama? Una tink sey I sell una as slave like man wey sell en shidren? No! Una bi slave, bikos of una sins and dem karry una komot from una land, bikos of di bad-bad tins wey una do.


“ ‘If una fellow Israel pipol wey dey stay near una dey poor kon sell ensef for una to bi slave, una nor go make am do di work wey oda slaves dey do.


As di king dey shek di akkount, dem kon bring one savant wey dey whole 10,000 koins kom.


Wen two of dem nor fit pay di money back, e kon sey make dem forget about di money. Afta dat, wish of dem go like di man pass?”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ