17 If e nor asept wetin dem tok, make yu tell di church leaders. If e nor gri listin to wetin di church leaders tok, den make una trit am like sina or tax kollector.
Den Israel pipol wey kom back, chop di sakrifice with doz wey don stop to serve di juju wey di pipol wey dey di land before, dey serve. All of dem kon woship di Oga wey bi Israel God.
But wen Man Pikin kom, e chop and drink and una sey, ‘Si am, long-trot, drunkaman, tax kollectors and sinnas friend!’ But God wisdom dey show for wetin e dey do.”
Di Farisee kon stand dey pray about ensef sey: ‘God, I tank yu sey I nor bi like oda pipol wey dey play wayo, dey sin, pipol wey dey kommit adultery or even like dis tax kollector.
My brodas and sistas, wi dey kommand una with awa Oga God Jesus Christ name sey, make una nor follow bilivers wey dey do anyhow and nor dey do as wi tell dem.