Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 18:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 “Wetin yu tink? If pesin get hundred sheep and one waka lost, e nor go leave di ninty-nine for di bush go find di one wey lost?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 18:12
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den God tell Profet Elijah wey kom from Tishbe sey,


I dey waka go like sheep wey waka lost for bush, so make Yu kom find mi, bikos I neva forget yor laws.


All of us bi like sheep wey don lost and wi dey waka go awa own way. But God gi-am di ponishment wey suppose bi awa own.


My pipol bi like sheep wey waka lost. Who dey guide dem don make dem lost. Dem dey waka anyhow for di mountins; dey from one hill go anoda. Dem don forget dia place where rest dey.


just as shepad dey kare for dia sheep wey skata kon gada dem again. For dat day wen di wahala go start, I go bring dem kom back from where dem skata go.


“Doz wey don lost and wey waka anyhow, I go find and bring dem kom back. Doz wey get sore, I go bandage am for dem kon heal doz wey dey sick; but doz wey fat and strong, I go distroy dem, bikos I bi shepad wey dey do wetin dey rite.


Di kountries wey hate dem nor go disturb dem again and wiked animals nor go kill or chop dem again. Dem go stay for peace and nobody go make dem fear again.


Una nor gri kare for di ones wey dey weak; heal di ones wey dey sick; bandage di sore wey some get; go find di ones wey waka anyhow or look for di ones wey lost. Instead, una dey trit dem with wikedness.


So my sheep kon dey waka anyhow on-top di hills and mountins. Dem skata for evriwhere for di eart and nobody dey to guide or look for dem.


Jesus ansa, “If any of una get sheep wey fall inside pit for Sabat Day, e nor go-go karry am out?


I tell una true word, wen e si am, e go happy for dat one pass di ninty-nine wey nor lost.


“Wetin una tink? One man get two boys. E tell one, ‘My pikin, go work for my farm today.’


“Wetin una tink about Christ, wey bi di Mezaya? Wish pesin pikin e bi?” Dem kon ansa, “Na David Pikin.”


I dey tok to pipol wey get sense. Make una tink about wetin I dey tok.


Before-before, una waka komot for di rite road like sheep wey lost, but naw, una don turn back go meet di Shepad and Pesin wey dey guide una soul.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ