8 Wen dem look up, di only pesin wey dem si, na Jesus.
But Jesus tosh dem kon sey, “Stand up! Make una nor fear.”
As dem dey kom down from di mountin, Jesus warn dem sey, “Make una nor tell anybody dis vishon wey una si until God go wake Man Pikin from deat.”
Wen dem look round, dem nor si anybody escept Jesus.
Afta di vois don tok finish, Jesus kon dey alone for di place, but di disciples kwayet and dem nor tell anybody wetin dem si.