Pita ansa, “Yes.” As Pita enter di house, Jesus kon ask am, “Wetin yu tink, Simon? Who dey pay tax give kings for dis world? Na pipol for di kountry or strenjas?”
but make dem nor for kause trobol, make yu go trow hook for river. Di first fish wey yu go katch, wen yu open en mout, yu go si money for inside, den make yu take di money pay di tax for mi and una.”
“Di oga praiz di wayo manaja, bikos of di wayo sense wey e use. Bikos dis world pipol sabi use dia wayo sense for business pass pipol wey dey for lite.
Di men for Israel kon sey, “Yu si dis man wey dey kom out always? E dey do like dis to shalenge all Israel. But awa king don sey, ‘Anybody wey go fit kill di man, e go gi-am money and en dota make e marry and di pesin papa house nor go dey pay tax again.’ ”