Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world. Wi si en glory wey show sey, naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut, wey God send kom meet us.
Papa, I wont make di pipol wey yu give mi stay with mi for where I dey, so dat dem go si di glory wey yu give mi, bikos yu love mi before yu kreate di world.
Make una nor bi like pipol for di world, but make una allow God shange una mind, den una go know how to serve God and do tins wey dey make belle sweet am.
Den I si anoda angel wey get pawa dey kom down from heaven inside kloud and rainbow dey on-top en head. En face dey shine like sun and en leg bi like big fire.