11 Jesus ansa, “Na true sey Elijah go first kom and e go ripair evritin.
Wetin e go prish, go make papa setol with dia shidren and shidren go setol with dia papa. If not, I go kom skata and distroy di land.”
Di disciples ask am, “Why di law tishas dey tish sey na Elijah go first kom?”
And I tell una sey, dat Elijah don kom, but pipol nor know am, instead dem do am as dem like. Na so too, God Pikin go sofa for dia hand.”
So wen dem gada, dem kon start to ask Jesus Christ, “Oga God! Na naw yu go start to rule Israel?”
Dis Jesus Christ go stay for heaven till di time wey God go make evritin betta again as E don tok thru en holy profets.