1 Afta six days, Jesus take Pita, James and John (wey bi James broda), go on-top one high mountin.
Jesus body kon shange. En face kon dey shine like sun and en dress kon white.
E take Pita, James and John, wey bi Zebedee two shidren, with am. But bikos of wetin won happen, belle nor sweet am.
As Jesus sidan for Mount Olives wey face di temple, Pita, James, John and Andru kom meet am wen odas nor dey and dem kon sey,
Jesus nor let anybody follow am espect Pita, James and John, wey bi James broda.
Wen dem rish di house, Jesus nor let anybody follow am enter, escept Pita, John and James with di pikin papa and mama.
Na di third time wey I dey kom visit una bi dis. If dem sey pesin do bad, two or three pipol must sey, na true, before pipol go bilive am.
Bikos, wi nor use awa brain take tell una lie-lie story about Christ pawa and how E go kom back.
Wen dis vois tok from heaven, wi awasef hear am, bikos wi dey with am on-top di mountin.