If yu fit sey e nor koncern yu, God know and dey judge evritin wey yu dey do. E dey look yu and E know yu well-well. E go reward yu akordin to wetin yu do.
Na di pesin wey sin, go die. Pikin nor go sofa, bikos of en papa sin and papa nor go sofa, bikos of en pikin sin. Pesin wey good, God go pay am for en goodness, but wiked pesin go sofa di wikedness wey e do.
Di king go kry well-well; di prince nor go get hope again and di pipol go dey shake, bikos dem dey fear. I go ponish una for evritin wey una do and just as una judge oda pipol, na so too I go judge una. Den una go know sey na mi bi God!”
River with fire dey kom out from di throne. Pipol wey dey woship am, many well-well. Many-many pipol still dey wait to kom woship am. Den dem open di book, bikos dem won start to judge kase.
Una go from dis valley go di mountin kon eskape go di oda side. Una go run, just as una grand-grand papa dem do wen groun open for di time wen Uzzaya bi king for Judah. Den all di angels go follow Oga God wen E dey kom.
“Den Man Pikin sign go appear for heaven and all di tribes for dis world, go kry. Dem go si God Pikin dey kom from inside di kloud for heaven with pawa and betta glory.
If anybody shame for mi and wetin I dey tish for dis world wey wiked and ashawo pipol dey, Man Pikin go shame for am too, wen e go kom back for en Papa and en holy angels glory.”
Den di rumor kon dey spread among di brodas and sistas sey, di disciple nor go die. But Jesus nor really tell Pita sey di oda disciple nor go die, but e sey, “If I won sey make e stay until I kom back, wish one koncern yu inside?”
kon sey, “Galilee pipol, na wetin make una stand der dey look heaven like dat? Dis Jesus Christ wey God don karry go heaven today, go still kom back di same way wey una si am dey go heaven.”
God big angel go shaut dey kommand as Christ dey kom down from heaven; di angel vois go dey loud with God trumpet and doz wey bi Christian before dem die, go first go up.
My brodas and sistas, make una get patient till Christ go kom back. Tink how farmer dey wait for wetin e plant until e grow kon bring food wey dear and e dey wait with patient for am, until di first and di last rain go fall put.
(Make una look! E dey kom back inside di kloud and evry eye go si am. Even doz wey shuk am and all di tribes wey dey dis eart, go kry bikos of am. Dis tins go really happen! Amen.)
And I si di pipol wey don die, both big and small, as dem stand for di throne front. Dem open plenty books and den kon open anoda book wey bi di Life Book. And dem judge doz wey don die akordin to wetin dem rite for di books sey dem do.