26 Wetin pesin go gain, if di whole world bi en own, but e luz en soul? Or wetin pesin go fit give take pay for en soul?
Satan ansa, “Di true bi sey, pesin go give Yu evritin wey e get, so dat e nor go die.
Doz wey nor know God before dem die, na wish kind hope dem get?
Anybody wey won save en life, go luz am, but anybody wey luz en life bikos of mi, go gain am.
God Pikin and en angels go kom inside en Papa glory, den e go reward evribody akordin to dia work.
If yor rite eye go make yu sin, make yu plok am komot. E betta sey one part for yor body nor dey, dan sey all yor body enter hell-fire.
“But God kon tell di man, ‘Yu bi fool! Dis nite, yu go die, den who go kon get all dis tins wey yu don gada for yorsef?’
“But Abraham ansa, ‘My pikin, remember sey wen yu dey alive, yu dey enjoy good tins, but Lazarus nor enjoy at-all. But naw, e dey enjoy for here and yu dey sofa for der.
Wetin pesin go gain if e get di whole world, but e luz en soul?