23 But Jesus turn face Pita kon sey, “Satan, komot for my front! Yu bi stone wey block road, bikos yor mind nor dey for wetin God wont, but na wetin man wont.”
God tell Adam, “Yu obey yor wife kon chop from di tree wey I kommand yu sey, ‘Make yu nor chop from.’ “Bikos yu do dis, I curse di groun. Yu go work hard to make di groun bring food till yu die.
But David tell Abishai and Joab en broda, “Who make una judge? Yu won give mi trobol? Na mi bi Israel pipol king naw and nobody go kill Israel pesin today,”
But Jesus turn look en disciples kon shaut for Pita, “Satan! Make yu go my back, bikos yu nor put yor mind for wetin God wont. Na wetin human being wont, na der yor mind dey.”
Dem go end for hell; na dia belle bi di god wey dem dey serve. Tins wey suppose make dem shame, naim dey make dem happy and na only tins for dis world dem dey tink about.