I go really bless yu kon make yor shidren-shidren plenty well-well and nobody go fit kount dem, just as nobody fit kount stars for sky or di san-san wey dey near river. Yor shidren-shidren go take all di tins wey bilong to dia enemies.
E go give wisdom to doz wey dey judge, so dat dem go judge well. E go give strong heart to doz wey dey defend di town, so dat dem nor go fear any attack.
But nor-tin wey pipol use against una, go fit distroy una; una go ovakom evribody wey dey akuiz una. Dis na wetin pipol wey dey serve Mi dey enjoy and I go defend and make dem win.” Na so God tok!
Una wey bi Kapanaum pipol, una feel sey una fit karry unasef go heaven? No! God go trow una for hell-fire, bikos if to sey dem do di mirakles wey dem do for una, for inside Sodom, di town for still dey till today.
If e nor asept wetin dem tok, make yu tell di church leaders. If e nor gri listin to wetin di church leaders tok, den make una trit am like sina or tax kollector.
As Jesus dey waka for Galilee wotaside, e si two brodas, Simon wey dem dey koll Pita and Andru en broda, dem dey trow net inside di river dey katch fish.
Andru kon bring Simon kom meet Jesus. Wen Jesus si am, e tell am, “Yu bi Simon, John pikin, na Cefas (wey mean Pita) pipol go dey koll yu from today go.”
Make una take kare of unasef and all di pipol wey di Holy Spirit don put under una, bikos na una bi di leaders for God church wey E buy with en only pikin blood.
Saul happy wen dem dey kill Stefen. Na from dat day trobol start for di church wey dey Jerusalem and all di bilivers kon skata go Judea and Samaria, but na only di apostles nor run.
so wen James, Pita and John wey bi leaders for di church, si sey God give mi grace, dem kon dey support mi and Banabas sey, “Make wi dey prish give Gentile pipol and doz wey dem sekonsaiz.”
E make dem undastand, so dat thru di church, all di rulers and pawas wey dey heaven go kon know God komplete wisdom, wey dey show ensef for difren ways.
Since wi don receive di kingdom wey dem nor fit skata, make wi tank and woship God with respet and fear. Make wi gi-am di kind woship wey go make belle sweet am.
Di sevent angel blow en trumpet and one loud vois kon shaut from heaven: “All di kingdom for di world don bi God and Christ own. E go rule forever and ever.”