God sey, “Dis pipol sey dem dey obey mi, dem dey tok good-good tins about mi, but dem nor really dey respet mi and evritin wey dem tok nor rish dia heart. Dia relijon na law and tradishon wey human being make with dia own hand.
I go ponish una. I go bring distroshon to una; diziz wey dem nor go fit cure and fever wey go make una blind, naim I go take waste una life. Una go plant una seed, but e nor go produce good food for una, bikos una enemies go win una kon chop wetin una plant.
but dey waste oda pipol time with di words wey dem dey tok. Dis kind tin dey make pipol live yeye life, instead of to dey hear God word wey dey make pesin faith strong.
Make una nor let difren-difren prishin wey una nor know turn una head. Una spiritual pawa dey kom from God grace, nor bi from food wey dem sakrifice, bikos di sakrifice nor fit help pipol wey dey do am.
I dey warn evribody wey dey read di profesy wey dem rite for dis book: If anybody add join wetin dey dis book, di wahala wey dey dis book, God go add am join en life.
Naw, David dey tink for en mind sey, “As I guide evritin wey bi dis man own for desert rish, so e nor mean anytin to am? I nor take anytin from am. But e don use wikedness take pay di good wey I do for am.