37 Di pipol chop beleful and di food wey remain, full seven basket.
So e give di pipol and just as God tok, dem chop beleful and some still remain.
Bikos E dey give wota to pipol wey nid am and food to doz wey dey hongry.
Di disciples ansa, “As dis pipol plenty so, where wi go fit get food wey go rish dem chop for dis wildaness?”
Di men wey chop na 4,000, even doh dem nor kount wimen and shidren join dem.
E don make doz wey dey hongry beleful with good food and pipol wey get money well-well, E don make dem poor.
But one nite, di pipol wey dey follow Saul kon put am for basket, trow am down small-small from one small window wey dey near di town fence.