25 Di woman knee down for en front kon dey beg am sey, “Oga God, make yu help mi!”
Den di man sey, “Make yu allow mi dey go, bikos day don dey break.” But Jakob ansa, “I nor go let yu go, unless yu bless mi.”
E fight with God angel kon win. E beg di angel make e bless am. E meet God for Bethel and God kon tok with am for der.
Den di oda disciples for di boat kon bow down for Jesus front woship am sey, “True-true, yu bi God Pikin.”
Jesus tell am, “E nor good to give dog di bread wey shidren suppose to chop.”
Pipol kon dey shaut for dem make dem kwayet. But dem kon dey shaut more-more, “David Pikin, make yu sorry for us.”
One leper kon meet am, knee down for en front, kon sey, “Oga God, if yu wont, yu go fit heal mi, so dat my body go well.”
Di spirit dey always trow am inside fire or wota make e for die. But if yu go fit do anytin, make yu sorry for am and help us.”
Kwik-kwik di boy papa kon shaut, “I bilive o-o! Help mi make I bilive more-more!”