Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 15:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Na from pesin heart bad-bad tins dey kom out and na dis tins dey make dem kill; sleep with who dem nor marry; tif; lie and judge pesin for en back.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 15:19
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But di Oga God si as human being wikedness don strong for di eart. Evritin wey dem dey tink for dia mind, na how to do evil tins.


Di ofrin smell kon make belle sweet God, so E tell ensef, “I nor go ever curse di eart again, bikos of wetin human being do; even doh I know sey since wen I kreate dem, na only bad tins dem dey tink. I nor go ever distroy evritin wey get life as I don do so.


I hate pipol wey dey pritend sey dem dey loyal to evribody, but I love yor kommandment.


Shidren nor dey know sey di way dem dey bihave nor good, but betta korreshon go tish dem how to bihave well.


bikos anytin wey foolish pesin plan, dey make pesin sin and pipol nor like pesin wey dey laf odas.


Make yu dey kareful about wetin yu dey tink, bikos na wetin yu tink for yor heart, yu go do.


Na bad plans full dia heart and na so-so trobol dem dey kause.


Make wiked pipol turn from dia wiked life kon shange di way dem dey tink. Make dem turn go meet di Oga wey bi awa God, bikos E dey sorry for pesin and dey kwik forgive pipol.


Na only evil tins una dey plan to do. Una nor dey fear to kill innocent pipol. Anywhere wey una dey go, na only wahala una dey kause for der


Na wikedness full human being mind and e bad well-well. Na who go fit undastand am?


“So Jerusalem pipol, make una from una heart stop all di bad-bad tins wey una dey do, so dat una go dey save. Wetin make una nor fit stop to tink bad-bad tins?


Balaam ansa di donkey, “Na bikos yu make mi look like fool: if to sey I get swod for my hand, I for don kill yu naw.”


Na all dis tins dey make pesin dirty, nor bi bikos pesin chop with en hand wey e nor wosh.”


But I dey tell una naw sey, ‘Anybody wey look woman kon get di mind to sleep with am, don already kommit sin for en heart.’


Wen Jesus know wetin dem dey tok, e kon ask dem, “Wetin make una dey tink dis kind bad tin for una mind?


So make yu turn from sin kom meet God and from di bad tins wey dey yor mind and pray make God forgive yu.


I know sey wetin dey inside mi nor go let mi do good. Even wen I won do good, I nor dey fit.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ