15 But Pita tell Jesus, “Tell us wetin yu mean.”
“So, make una undastand wetin di farmer parabol mean:
Den Jesus kon leave di pipol enter inside house. En disciples kon tell am, “Tell us wetin di grass parabol for farm mean.”
Jesus ansa, “Afta evritin wey I don tok so, una nor still undastand?
E nor get wetin e tell dem wey e nor use parabol. But wen only en and di disciples dey, e dey esplain evritin give dem.
Wen Jesus leave di pipol enter house, en disciples kon ask am about di parabol.
En disciples kon sey, “Yu si, na naw yu dey tok for di way wey wi undastand and nor bi with parabol.