30 But wen e si as di breeze strong rish, fear katch am and e kon bigin sink. So e shaut, “Oga God, save mi o-o!”
Wen Elisha savant get up for early morning go outside, e kon si sey sojas surround di town with dia horse. Den e go tell Elisha, “Oga! Na die wi dey so o-o, wetin wi go do naw?”
My God, make Yu get up! My God, make Yu save mi! Yes, Yu go slap all my enemies for dia face kon break dia tit!
So, Jesus tell am, “Make yu kom!” Pita komot from di boat kon dey waka on-top di wota go meet Jesus.
At wons, Jesus stresh en hand katch am kon tell am, “Yor faith too small. Why yu dey doubt mi?”
Make yu nor sleep, but dey pray make yu nor for fall enter temptashon. Man spirit won pray, but en body dey weak.”