King Herod kon hear wetin dey happen, bikos pipol don know Jesus name well-well. Some pipol sey, “John wey dey baptize don wake-up from deat and bikos of dis, e don get pawa to do mirakles.”
Wen Herodias dota kom dance, Herod and di pipol wey e invite kon dey happy well-well. So di king kon tell di girl, “Make yu ask mi for anytin wey yu wont and I go give yu.”
Herod with en sojas too dey take Jesus make yeye and dey laf am. Den Herod sey make dem wear fine klot for Jesus body, den make dem take am go back go meet Pilate.
Tiberius Caesar don dey rule for fifteen years wen Pontius Pilate bi govnor for Judea and Herod dey rule Galilee, en broda Filip dey rule Iturea and Trakonitis aria and Lysanias dey rule Abilene.