23 Afta di pipol don go, Jesus kon klimb go mountin go pray. E stay der go rish evening.
Den Jesus go Getsemani with en disciples kon tell dem, “Make una sidan here bikos I wont cross go di oda side go pray.”
But wen una dey pray, make una go inside room, klose di door and pray to una Papa for sekret. And una Papa wey dey si for sekret, go reward una for pipol present.
For early morning wen evriwhere still dark, Jesus leave di house go one kwayet place go pray.
Afta e don tell dem bye-bye, e kon go pray for one mountin.
So wen all di pipol don baptize, Jesus ensef kon baptize too. Wen e dey pray, heaven open,
But Jesus komot go pray for wildaness, where pipol nor dey.
Jesus go mountin go pray and e dey der dey pray to God till day break.
As Jesus dey pray alone and en disciples dey near am, e kon ask dem, “Na who pipol dey tok sey I bi?”
One week afta Jesus tok all dis tins, e kon take Pita, John and James go on-top one mountin go pray.
So dat wi go fit put awa mind for prayer, as wi dey prish God word.”