Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 14:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Den e tell di pipol make dem sidan for di grass. E take di five bread and two fish face heaven kon tank God. Afta e don tank God, e share di bread give en disciples make dem give di pipol.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 14:19
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Jesus ansa dem again, “Make una bring di bread and fish kom.”


Jesus kon tell di pipol make dem share diasef into group, sidan for grass.


Jesus take di five bread and two fish, e look heaven kon tank God, den e divide di bread. E give en disciples make dem share am for di pipol and e kon divide di two fish among dem too.


Den e look heaven kon sey, “Efratah!” (wey mean, “Make yu open”).


Den Jesus take one cup wey get wine, afta e tank God, e kon sey, “Make una take dis cup and divide am among unasef.


Den Jesus take bread, afta e tank God, e divide am kon gi-am to dem sey, “Na my body bi dis, wey God don give una. Make una dey always do dis tin to take remember mi.”


E sidan for where dem dey chop; e take bread, bless am kon divide am give dem.


(Di men wey dey der alone rish 5,000). Jesus tell en disciples, “Tell di pipol make dem sidan fifty-fifty.”


Den Jesus take di five bread and two fish, e look heaven, tank God, den e kon divide dem. E give di bread and fish to en disciples, make dem share am for di pipol.


So, dem kon roll di stone komot from di grave mout. Den Jesus look heaven kon sey, “Papa, I tank Yu sey Yu dey always hear mi and dey do di tins wey I ask from Yu.


So some kenu wey kom from Tiberias kon rish di wotaside near di place wey dem for chop bread, afta Jesus don pray.


Wen Paul tok finish, e take bread kon tank God for dia front make all of dem si and e start to chop.


Anybody wey tink sey one day betta pass anoda, dey do so to honor God. And anybody wey chop meat, dey tank God just like di pesin wey nor won chop.


Wen wi drink from di Oga God Supper cup, dat mean sey wi dey share from Christ blood. Wen wi chop from di bread wey wi divide, dat mean sey wi dey share for Christ body.


But anytin wey una dey do, weda una dey chop or drink, make una do am to honor God.


and afta e don tank God, e divide am kon sey, “Dis na my body wey I dey give una. Make una always dey chop am to remember mi.”


For anytin wey una dey do, weda una dey tok or do oda tins, make una do am with awa Oga God Jesus Christ name and tank God thru am.


And wen una enter di town, una fit si am, before e go-go chop for di altar for di hill. Di pipol nor go chop until e kom, bikos e must bless di sakrifice. Wons e don bless am, doz wey dem invite go bigin chop. Naw make una dey go, bikos na naw una go fit si am.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ