Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 13:52 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

52 Den Jesus kom tell dem, “Anybody wey dey tisha di law and e bi disciple for God Kingdom, go bi like pesin wey get house kon bring new and old tins kom out from inside di house.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 13:52
31 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Ezra main work na to dey study God law, pratise am and tish Israel pipol how to obey God.


I kommand sey make all di ofisas wey dey keep money for West Eufrates aria provide for Priest Ezra wey know God for heaven law. Make una give dem


Ezra go skool and e know di law wey di Oga wey bi Israel God give Moses, well-well. Bikos God dey with Ezra, di king dey gi-am evritin wey e ask for.


Raitious pipol fruit bi like tree wey dey give life, but pesin wey dey prish give odas to turn kom meet God, get sense.


Na good advise dey kom out from wise pipol mout; but foolish pipol heart nor get anytin to give.


Word wey pesin tok fit give yu sense wey deep like sea and fresh like river wey dey flow.


Di mandrake fruit and di fruit wey fine pass, dey give us sweet smell. My darlin, difren kind of good tins dey awa door-mot and I don keep both old and new wons for yu.


As good pesin dey bring good tins from en heart, na so bad pesin dey bring bad tins from en heart too.


Jesus ask dem, “Una undastand all dis tins?” Dem kon ansa, “Yes.”


Wen Jesus tok di parabol finish, e kon komot for der.


I go send profets, wise pipol and law tishas kom meet una and una go kill and nail some for cross, flog some inside una sinagog, den porshu di odas from one town go anoda.


So make una go make pipol my disciples for di whole world, dey baptize dem with di Papa, di Pikin and di Holy Spirit name,


Na dis one make God tok with en wisdom sey, ‘I go send profets and apostles go meet dem and dem go sofa and kill some among dem.’


“I dey give una new kommand: Una must love each oda, as I love una,


wi dey like sey wi dey vex, but wi dey always happy; wi bi like poor pipol, but wi dey make many pipol rish; wi bi like who nor get anytin, but wi get evritin.


so dat wen una read am, una go fit undastand di sekret wey God show mi.


Na mi small pass for all God pipol, but God don give mi grace to prish di Good News give Gentile pipol and dis grace wey Christ give mi, nor dey finish.


Awa broda Epafras, wey dey work for Christ with all en mind, even doh wi nor dey der, na-im tish una di gospel


Make Christ word stay inside una and make una dey tish each oda with wisdom wey go make una heart strong. Make una dey sing psalms, hymns and spiritual song and dey do all dis tins to really tank God from una heart.


Who won bi leader must bi pesin wey get strong faith, bikos if e nor strong for faith, e go start to karry body up, den Satan go ponish am.


E must bilive di message about God wey e dey tish, so dat e go fit tell pipol di trut and korrect doz wey dey oppoz am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ