James and John wey bi Zebedee shidren, wey dey follow Pita work, sopraiz too. Den Jesus tell Simon Pita, “Make yu nor worry, from today go, na pipol yu go dey katch.”
E dey kut evry branches wey nor dey bear fruit for my body komot and e dey ripair evry branch for my body wey dey bear fruit, so dat e go bear more fruit.
I don travel many times wey I enter trobol for wota; for tif hand, even for my kountry pipol and Gentile pipol hand; both for inside town; for wildaness and from pipol wey dey pritend sey dem bi awa brodas.
“Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Sardis: ‘Di Pesin wey whole God seven spirits and di seven stars: I know wetin yu dey do; for pipol eye, yu dey alive, but true-true, yu don die.