45 “Again, God Kingdom bi like trada wey dey look for betta gold to buy.
Wisdom get betta value pass diamond or fine glass.
So, since yu don hear evritin, dis na my last advise: “Make yu fear God and obey all en kommands, bikos na wetin man suppose do, bi dat.”
So di tisha sey, “Evritin dey yuzles. Yes! Dem yuzles well-well.”
Jesus kon tell en disciples anoda parabol, “God Kingdom bi like wen pesin plant good seed for en land.
Wen e si one gold wey dear well-well, e kon go sell evritin wey e get buy am.
Wetin pesin go gain, if di whole world bi en own, but e luz en soul? Or wetin pesin go fit give take pay for en soul?
“But di pipol nor gri listin to wetin di savants tok, instead one go en farm and di oda kon go do en business.
“Make una nor give dog tins wey dey holy or trow yor gold give pig, bikos dem go mash am with dia leg, turn face yu, den kon tear yu to pieces.